Skip to content

Focus News Online

Nose For News…

Menu
  • NewsNews
  • PoliticsPolitics
  • BusinessBusiness
  • SPORTS
  • EntertainmentEntertainment
  • Focus Magazine
  • Privacy Policy
  • About Us
Menu

How much you go pay now for data and calls in Nigeria after government approve 50% tariff hike for telcos?

Posted on January 22, 2025 by Sonia Onoja

As di Nigeria Communication Commission, NCC announce say dem don approve a 50% tariff hike for telecommunications companies in di kontri, di question wey dey ground now na how dis increment go impact Nigerians.

Dis development mean say definitely, di money to make calls and buy internet bundles go increase across all di telecommunication companies.

For instance, if di price of one-minute call bifor na 10 naira, now e fit be 15 naira, and if di price of one gigabyte of data na N1000, e fit increase to N1,500.

Dis dey come as pipo for Nigeria still dey struggle wit rising inflation and a cost of living wey don dey shoot above di roof.

Di inflation rate for Nigeria stand at 34.80% in December 2024 and Nigerians bin don face increases in fuel price and electricity tariff among oda price hikes.

For dia statement on Monday, di NCC – wey be di body wey dey regulate telecommunication for Nigeria – say dem recognize di pressure wey pipo and businesses dey go thru, and dem no happy to do dis increment, but dem no fit escape am and e go help greater coverage by network providers.

So how much exactly go be di new cost of calls per minute and data per gigabyte for Nigeria? And wen dis new price increment go take effect?

Nigeria get four major telecommunications company wey dey provide call and internet services to millions of dia customers. Di companies na MTN, Glo, Airtel and 9Mobile.

According to di NCC, dis telecom operators bin ask for a 100% increase in tariff, but na only 50% goment approve for dem.

Normally, di cost of call per minute dey depend on which subscription package di customer choose.

For instance, MTN voice package for local calls include Pulse, Beta Talk, True Talk, Awuf4U and Extra Special.

Bifor now, MTN dey charge Pulse subscribers N24.30 for di first 90 seconds call of di day, and afta dat di charge go be 11.26 kobo per second or N6.75 per minute.

Dis mean say for di old tariff, N100 airtime go reach pesin to make call for 14.8 minutes wit MTN pulse, but wit dis new 50% increment, na only about 7.4 minutes call di pesin fit get.

Di calculation na almost di same tin on top all di major operators for di telecoms industry.

Similarly, di price of 50 megabytes of internet data ontop Glo Mobile, for instance, go now fit increase from N50 to N75, while 3.9 gigabytes wey pesin fit buy wit N1000 bifor, from now fit be N1,500.

Also, Short Message Services (SMS) wey be four naira bifor across board, fit now increase to six naira.

One senior staff of 9Mobile wey speak to BBC Pidgin on top dis matter say di company go soon inform dia customers publicly on wetin go be di exact cost of calls and data once dem finalise dia calculations.

Leave a Reply Cancel reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

This site uses Akismet to reduce spam. Learn how your comment data is processed.

Recent Comments

  1. Lawrence Orji on President Ahmed Bola Tinubu Reconciled with Mallam Nasir El-Rufai Former Governor of Kaduna State on the Occasion of his 65th Birthday
  2. Samuel on The clear message from President Donald Trump why USA Government is arresting and deporting Nigerians.
  3. Samuel on Breaking: We are doomed Over 1.9 million people are living with HiV in Nigeria
  4. Sonia Onoja on The clear message from President Donald Trump why USA Government is arresting and deporting Nigerians.
  5. Moses Adebisi on Amb. Mosses O. Adebisi Ph.D. is without question. The Embodiment of Hope For The NLM’S And Nigeria’s Future

Recent Posts

  • Breaking: US Freezes Assets of 8 Nigerians over Alleged Cybercrime, Boko-Haram, ISIL Ties
  • Breaking: US Freezes Assets of 8 Nigerians Over Alleged Cybercrime, Boko Haram, ISIL, Ties
  • Senate Finally Reveals Why Real Time was Removed from Electoral Bill
  • Hon. Johnson Samuel Ani: An Epitome of True Leadership
  • Breaking: Court Nullifies PDP Ibadan National Convention, Recognises Abdulrahman-led Caretaker Committee as Authentic Chairman
©2026 Focus News Online | Design: Newspaperly WordPress Theme
We use cookies to ensure that we give you the best experience on our website. If you continue to use this site we will assume that you are happy with it.